Who did Maria nominate for eviction: Pere, Angel, Yousef, Jaypaul, Emmanuel and JMK na di housemates wey Maria nominate for evictionEven though Biggie bin tell Maria say e dey introduce new twist dis week, di head of house name Pere, Angel, Yousef, Jaypaul, Emmanuel and JMK as her pick for possible eviction. On Monday 16 August, Biggie tell Maria to pretend say na she get di power to pick di two housemates wey go dey evicted on Sunday meanwhile di truth be say nomination and eviction no go hapun dis week but Maria go need to pretend say eviction go hapun and na her hand e dey.

Even though Biggie bin tell Maria say e dey introduce new twist dis week, di head of house name Pere, Angel, Yousef, Jaypaul, Emmanuel and JMK as her pick for possible eviction. On Monday 16 August, Biggie tell Maria to pretend say na she get di power to pick di two housemates wey go dey evicted on Sunday

 

 

 

 

meanwhile di truth be say nomination and eviction no go hapun dis week but Maria go need to pretend say eviction go hapun and na her hand e dey, According to wetin Biggie tok. Maria go need to make di housemates believe say na she go determine di two housemates

 

 

 

 

 

wey dey go home on Sunday and say she go choose dem based on di least housemates wey impress her during di week. Big Brother meanwhile cut warning for her not to turn di housemates to ‘slaves’. Di organisers of di show announce on Sunday say make pipo expect “sweet surprises” as di live show go be one for di history books.

 

 

E no dey clear wetin go happun during di live eviction show today as Biggie bin tok say dem no go evict anybody. Also, fans go find out if Maria successfully keep di secret to herself throughout di week as she stand to win prize from Biggie if she succeed.